Hustle o’
Every social media platform has got these rib cracking trend on for a while now and we felt a compilation of it for the fun of it will make some sense to make you laugh and remind you to HUSTLE OOO…
1.HUSTLE O make dem no tell you say motor don full.
2. HUSTLE O make dem no tell you say “as I see that shirt I know say na you.”
3. HUSTLE O make conductor no tell you say make you go find change come.
4.HUSTLE O make dem no use picture wey you snap yesterday do throwback.
5.HUSTLE O make dem no hiss when they see your call.
6.HUSTLE O make you no dey wear “adieu baba” go club.
7. HUSTLE O make dem no use AC steal your girlfriend.
8. HUSTLE O make you no carry charger for neck dey find where dem on gen.
9.HUSTLE O make you no dey borrow house to knack.
10.HUSTLE O make dem no use emoji cover your face.
🤣🤣🤣